Dr Anu of Medcontour: Court convict Anu Adepoju over failed liposuction, Brazilian butt surgery - BBC News Pidgin (2024)

Dr Anu of Medcontour: Court convict Anu Adepoju over failed liposuction, Brazilian butt surgery - BBC News Pidgin (1)

Wia dis foto come from, INSTAGRAM/MEDCONTOUR

Di former oga of di Federal Competition and Consumer Protection Commission (FCCPC), Babatunde Irukera say court don convict one medical doctor Dr Anuoluwapo Adepoju ontop accuse say her medical services dey cause injuries to customers.

Tori be say di Federal High Court wey sit for Lagos State bin convict Dr Anu of di five-count charges wey FCCPC bin bin sama her.

Dr Anu na di founder of MedContour Services Ltd, and she enta gbege for 2020 wen different ppipo bin accuse her say surgery wey she do for dem dey cause dem more injuries.

Sadly, one of Dr Anu client wey her name be Nneka Onwuzuligbo bin die in 2020 sake of wetin tori say dey linked to di surgery wey she do.

Dat time, na Irukera dey head FCCPC wey dey handle customer complaints for Nigeria.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

On Friday 17 May 2024, Irukera confam for im X page say dem don convict Dr Anu and her medical practice.

"Today na a day of pride for me say I personally prosecute Anu Adepoju and her medical practice. Though don comot, di case bin end in a conviction," Irukera write.

Skip Twitter post, 1

Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post, 1

Skip Twitter post, 2

Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post, 2

I no be plastic surgeon- Dr Anu

Dr Anu wey follow BBC News Pidgin tok for 2020 say she no be plastic surgeon as pipo dey refer to am. She say na cosmetic surgeon she be and she dey focus on liposuction.

"To sabi do cosmetic surgeon, di basic requirement na MBBS. I go for certificate course and I dey certified to practice cosmetic surgery," Dr Anu tok dat time for 2020.

Dr Anu: Fed goment don arrest woman wey pipo accuse of fake bumbum operation

Brazilian butt lift: ‘My bum-bum dey give me confidence’

'My breast wan kill me'

Omotola Taiwo, wey pipo sabi as 'Omohtee' share details wit BBC Pidgin for 2020 of how di cosmetic surgery wey she do don affect her mentally, physically and financially sotay she bin dey reason to kill hersef.

Di 28-year-old open up about di different fluids wey dey comot from her bodi and di pains wey she still dey feel six months afta her surgery.

Omohtee wey bin do 'top up' liposuction and Brazilian Butt Lift surgery as far back as January, 2020 for Lagos, Nigeria bin come out to accuse her surgeon, Dr Anu Adepoju say she do failed surgery for her wey don cause her serious health complications.

Dr Anu wey dey sue Omohtee for N25 million ontop defamation charges, also share her own side of di tori, dat time.

She bin insist dat time say she be qualified Doctor and Cosmetic Surgeon wey don train wit different ogbonge medical institutions and claim say she get over 1,000 successful surgeries to her name.

By dat time, di goment don lock up her clinic.

Dr Anu of Medcontour: Court convict Anu Adepoju over failed liposuction, Brazilian butt surgery - BBC News Pidgin (2)

Wia dis foto come from, X/FCCPC

Wetin happun bifor

For July 2020, di Federal goment of Nigeria bin arrest one Dr Anu of Medcontour and charge her to Federal High Court, Ikoyi, Lagos.

On Friday, 4 July 2020, Federal Consumer Protection Council (FCCPC) announce di arrest of Dr Anu wey her real name na Anu Fella, ontop accuse say she no cooperate with investigation into allegation of medical anyhow practice.

Dr Anu and her company bin don trend for social media many times over di last two years wen pipo go comot to accuse am say di cosmetic surgery she do ontop dia breast or bumbum come make dem worwor, or cause dem serious injury.

She don always comot to deny di accuse.

On 15 April 2020, authorities close Medcontour office for Lagos ontop accuse of "illegal activities" and say investigation go begin.

According to informate wey FCCPC release for july 2020, dis arrest and criminal charge na because Dr Anu no comply with di commission requirements for di investigation and say she no give dem di informate dem ask her for.

Oga of FCCPC wey dey incharge dat time Babatunde Irukera, wey imsef na lawyer, na di lead prosecutor for di case.

Dr Anu of Medcontour: Court convict Anu Adepoju over failed liposuction, Brazilian butt surgery - BBC News Pidgin (2024)

References

Top Articles
Latest Posts
Article information

Author: Tish Haag

Last Updated:

Views: 6087

Rating: 4.7 / 5 (47 voted)

Reviews: 94% of readers found this page helpful

Author information

Name: Tish Haag

Birthday: 1999-11-18

Address: 30256 Tara Expressway, Kutchburgh, VT 92892-0078

Phone: +4215847628708

Job: Internal Consulting Engineer

Hobby: Roller skating, Roller skating, Kayaking, Flying, Graffiti, Ghost hunting, scrapbook

Introduction: My name is Tish Haag, I am a excited, delightful, curious, beautiful, agreeable, enchanting, fancy person who loves writing and wants to share my knowledge and understanding with you.